Indian authorities don ban two of di very addictive opioids sake of one blukel investigation wey find out say dem dey ginger public health kasala for parts of West Africa.
For letter wey blukel see from di Drugs Controller General of India, Dr Rajeev Singh Raghuvanshi tok say dem withdraw di permission to make and export di drugs.
Aveo don dey illegally export one dangerous mix of tapentadol and carisoprodol for kontris like Ghana, Nigeria, and Cote D’Ivoire.
Di Food and Drug Administration for India say di company factory for Mumbai don since dey raided and dem seize dia whole stock.